Charly Boy has urged older people to also engage in self care
Sharing video of him getting groomed in a spa, he wrote;
”This grandpa eeeeeeeehn!
My people, I carry myself go do small microblading, removal of all gray hair yesooo, I say make I fine small.
Do u mind?
Clean face no be crime, abeg.
Na so I siddon, dem arrange my face, touch small here, fix small there, sharp sharp.
Make I tell una, this self-care no be only for small pikin or Gen Z people.
We go drag am.
Na for anybody wey value themselves.
Wey no carry Naija wahala for face.
You dey take care of your car, you dey take care of your house, ur chick, why you no go take care of your face? Na him people go fist see.
As we dey age, na so we suppose dey package ourselves.
No be vanity, na self-respect.
So if you see say my teeth white and my face dey shine, no talk say na filter, na maintenance.
This life no hard, if you wan dey happy, start from yourself.
Make I fresh small, I no kill person
If you believe say man suppose dey clean and sharp, drop your comment.
Self-care no get age limit”.
View this post on Instagram
Follow Us on Facebook – @LadunLiadi; Instagram – @LadunLiadi; Twitter – @LadunLiadi; Youtube – @LadunLiadiTV for updates




đź’Żđź’Ż