Lekki Husbands: Guess The Actresses Etcetera Took A Swipe At In New Husband/Divorce Drama?

    This Etcetera no well. Hahaha so he thinks some of us won’t
    decode the people he is referring to in his new article? Lol… don’t send me
    your link again, I no dey do again…. Ahn Ahn… these are our girls now, lol. Okay
    quick one, you guys are going to read about a divorcee whom her new guy fell in
    love with after seeing her in Jennifer. And that’s Funke Akindele. The second divorcee
    who just spent $24,000 on a yacht trip in Dubai- Chika Ike, while the 3rd who
    just bought a Lekki house and rumoured G-Wagon is Ini Edo. Oya read the gist,
    so you will understand what I am saying better. Lol… Funny guy…

    Hey Alfred’
    ‘Yes! Who be this?’
    ‘Ahan, you no get my number again? Na Frank dey talk.’
    ‘Hey Franko my guy.’
    ‘Alfred nawa oo, I don call you taya. Wetin happen wey you
    no gree pick my calls?’
    ‘Frank abeg no vex, I been dey inside one shop for “The
    Palms.”
    ‘Shuoo, person wey dey inside shop no dey pick calls again?
    Abi you dey with babe? Talk true.’
    ‘Frank abeg free me. No be babe mata dey do me now.’
    ‘Wetin happen Alfred? Why are you sounding like this today?’
    ‘Frank mehn, my wife don start her madness again. As I dey
    talk to you so, I wan leave her. I don taya I swear.’
    ‘Take am easy Alfred. Na the same wahala all of us wey marry
    celeb dey face. I even dey with Femi and Gbenga for here. If you hear their
    complaints, you sef go taya. Wait for us for “The Palms.” We go reach there in
    30 minutes time.’
    ‘Hey Alfredoski my guy!’
    ‘Femi how far? Hey Gbenga, where you buy this nice shirt?’
    ‘O’boy na my wife buy am for me oo. How your beautiful wife
    naa Alfred? Frank yarn us as we dey come say una wahala don start again.’
    ‘Gbenga I swear, I don taya for that girl.’ ‘Mehn, this sun
    na die. Abeg make we find somewhere to chill and take some bottles.’
    ‘Oya Alfred, gist us wetin happen between you and your wife
    this time around? But wait first Alfred, before you talk about you and your
    wife mata, are you not supposed to be at work at this time of the day?’
    ‘Why are you sounding like this Frank? Haven’t I told you
    that I don’t go to work whenever my wife is having menstrual pains?’
    ‘So wetin you come dey do for “The Palms”?’
    ‘Bros, she sent me to buy her sanitary pads and some
    chocolate.’
    ‘Shuoo your wife don turn you to houseboy finish ooo. So you
    no go work today because your wife wan eat chocolate and wear pad? Wonders
    shall never end. Na so she send you the other day go collect her purse wey she
    forget for another man house for Ikoyi.’
    ‘Gbenga abeg leave Alfred alone make him gist us wetin
    really happen between him and his wife this morning. That is why we stopped
    over.’
    ‘Ok, guys I was enjoying my sleep jeje this early morning,
    wey my wife come back from God knows where and woke me up to go and bathe her
    daughter. Before I say make I open my eyes, she don sprinkle water for my
    face.’
    ‘WHAT!!! So wetin you come do am?’ ‘Nothing na! Abi una want
    make I beat her? The water wey she pour for my face no even vex me like that.
    Na the insult wey follow the water make me vex. Na small thing remain I for
    slap her I swear.’
    ‘Mehn Alfred you messed up big time. If na my wife, I for
    use slap shave her eyebrows.’
    ‘Frank abeg make I hear word. Ok, make I slap her so that
    she go use me do publicity abi? Make she tell the world say I be wife beater
    abi? You know that our yeye press men won’t even bother asking my side of the
    story before writing their usual nonsense.’
    ‘Alfred, you and your wife mata na comedy I swear.’
    ‘Femi, wetin make you dey laugh? Shebi you sef dey plan to
    marry celeb? No worry, we dey wait. Don’t forget you already told me the reason
    you want to marry your celebrity girlfriend is because you loved the way she
    acted in the movie called “Jennifa.” You told Frank just two days ago that you
    are not very sure if her divorce went through the legal process of annulment or
    if it was just a case of her ex husband telling her to get out of the house and
    never come back again. Better find out the true reason for her divorce and if
    it was legally done so you don’t go to jail for bigamy.’
    ‘It’s ok Alfred.’
    ‘No Frank, let me finish what I am saying. After all we are
    all going through the same mess married to female celebs who have several
    divorces under their belt.’ ‘From what we all have seen of our celebrity wives
    and colleagues, none of us can vouch for our wives. Most female celebs are
    serial-cheaters and polyandrous. Some of them have married so many times that
    if they had a certificate for each divorce, the walls of their living rooms would
    be covered with frames like the office of the vice chancellor of UNILAG.
    Gbenga, why are you so quiet? How’s your wife?’
    ‘Frank, she’s fine jare.’
    ‘Is she back from Enugu? I taya oo. I wonder how long they
    will take to shoot a movie. Hope she calls sha?’
    ‘She called yesterday asking me to help her wash the pants
    she soaked in the laundry room two weeks ago before she travelled?’
    ‘My God, Gbenga please tell us you didn’t wash them. Did
    you?’
    ‘Yes I did, but before I did, I told her it would be the
    last time I’d ever wash her pants.’
    ‘Abegii, make we hear word. Who you dey lie for? Mehn, we
    don suffer for our wives hands sha. Frank, we heard your ex wife spent 24,000
    dollars on a yacht trip in Dubai a couple of days ago.’
    ‘Abeg make una let me hear word. She no fit afford such
    extravagance. Maybe she don catch another maga.’
    ‘Frank don’t tell us you are jealous. What makes you so sure
    that she can’t afford it? Didn’t you see my wife’s friend who just got divorced
    the other day in her brand new G-wagon and they say she has also bought a house
    for herself here in lekki?’
    ‘Gbenga you be mumu if you believe say na her money she take
    buy house and G-wagon. How much she dey collect per movie and how many movies
    she dey act?’
    ‘Abeg na dem sabi jare. Make I begin dey go. My wife go soon
    call to ask whether I don pick her daughter from school. I still get to cook
    for her and her friends this evening.’
    ‘Guys, me sef don waka oo, I no dey for my wife trouble.
    Femi, are you not going home? You wey go soon become the latest Lekki husband.
    But please make sure her previous marriage was legally annulled by a court of
    competent jurisdiction ok?’
    ‘You be our guy and we don’t want you to be like Gbenga
    whose marriage is illegal.’

    ‘Frank, better keep quiet there.’
    ‘Guys we go see later. Hey Alfredoski, take am easy with
    your wife oo.’

    Follow Us on Facebook – @LadunLiadi; Instagram – @LadunLiadi; Twitter – @LadunLiadi; Youtube – @LadunLiadiTV for updates

    LEAVE A REPLY

    Please enter your comment!
    Please enter your name here